US investigators dey try to establish how Oscar-winning actor Gene Hackman and im wife, classical pianist Betsy Arakawa, die afta dem discover dia deadi body dem for dia house for US state of New Mexico.
Dis na wetin we know so far about di death of di Hollywood legend wey dey known for feems like Di French Connection and Di Conversation.
How dem discover dia death?
Police find di couple body and one of dia dogs on Wednesday for dia house for dia Santa Fe house for US state of New Mexico afta one maintenance worker call emergency services.
One recording of di 911 call wey BBC get describe how di emotional caller tell one dispatcher how im find di two bodies.
Dem discover Hackman, 95, for one side room near di kitchen while Arakawa, 65, dem find her for bathroom, for di property on Old Sunset Trail for Hyde Park.
Tori be say e look like di couple bin don "die for quite a while", na so Sheriff Adan Mendoza tok.
Arakawa body show signs of "decomposition", and "mummification" for her hands and feet, na so sheriff detective tok.
Hackman deadi body "show obvious signs of death, similar and consistent" wit dat of im spouse.
Dem also find di couple German Shepherd dog dead for one bathroom closet near Arakawa.
Wetin we know about di cause of death for Hackman and Arakawa?
Police statement no give any cause afta dem announce dia deaths.
Di authorities bin no report signs of injury but dem say di death dey "suspicious enough" to investigate and dem no rule out foul play.
One portable heater dey near Arakawa head, wey detective believe say fit don come down for di event say she fall suddenly for ground.
Dem don request for Carbon monoxide and toxicology tests for both Hackman and Arakawa.
Di local utility company no find sign of gas leak for di area and di fire department no detect any indication of a carbon monoxide leak or poisoning, according to di search warrant.
Di warrant suggest say police fit get a working theory say "some kind of gas poisoning" happun but dem no know yet and dem no dey rule anytin out, na wetin Associated Press quote Loyola Marymount University law professor Laurie Levenson say she tok.
One prescription bottle and scattered pills bin dey for di bathroom countertop close to Arakawa body.
Hackman bin dey wear grey tracksuit bottoms, a blue long-sleeve T-shirt and brown slippers. Sunglasses and a walking cane dey next to im body.
Di detective suspect say di actor fit don suffer from a sudden fall.
Why authorities dey consider dia death as suspicious?
Di circumstances of dia death dey "suspicious enough in nature to require a thorough search and investigation", na wetin di search warrant say, becos di worker wey call di emergency services bin find di front door of di property open.
However, di detective observe no sign of forced entry inside dia home. Nothing appear out of place inside.
"No indication of struggle," na so Sheriff Mendoza tok. "No indication say anytin miss from di house or any disturbance, you know say, dat na indication say crime happun."
Dem discover two oda, healthy dogs wey bin dey roam di property - one inside and one outside.
Wetin we know about di time of dia deaths?
All we know na say two maintenance workers, one of dem call di emergency services, say di last time dem bin contact di couple na two weeks earlier.
Di two workers say sometimes wey dem dey do dia routine work for di property, dem dey rarely ever see Hackman and Arakawa.
Dem bin communicate wit dem by phone and text, primarily wit Arakawa.
Wetin we know about di couple health?
Hackman daughter Leslie Anne Hackman tell di Mail Online say her father bin dey in "very good physical condition" despite im age, and neva undergone "any major surgeries" in recent months.
"Im bin like to do Pilates and yoga, and im kotinu to do am several times a week," she tok. "So im bin dey in good health."
Di couple, marry for 1991, dem get a "wonderful marriage", she add put.
"I give credit to im wife, Betsy, for keeping am alive,' she tok. '[Betsy] bin take very, very good care of am and bin always dey look out for im health."
Comments
Leave a Comment